+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Daddy Freeze Use Style Tok 2face New Babe

‎As some pipo don dey blast Innocent Idibia, 2face as hin don really show he other face to him wife, Annie Idibia wey dey act film, say dem marriage nor fit work again.

‎Popular media person wey dey put mouth for everybodi problem, Daddy Freeze don solve one maths for di problem as he open up about di new woman wey 2face dey friend.

‎Noise start for social media on Sunday wey 2Baba go write for Instagram say he don seperate from Annie and dem go soon divorce after 12 years of marriage.

‎As pipo hear di news, see provocation from every cona but Daddy Freeze don use style take tok di new woman wey 2face dey follow, say na one honorable member.

‎Normally Daddy Freeze, dey close to Annie and 2face and he say Annie know say di singer bodi nor dey fit stay with woman but she karey leg still enta marriage with am, so make she dance di song wey di radio dey play.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM