+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dana Air Match To Head Office Ask For Salary Afta Sack

Afta Di wahala wey hapun to Dana Airlines as dem plane run komot from runway go enta bush, then Nigeria Civil Aviation Authority come suspend di company say dem go karey out audit, anoda mata don come up as staff wey di airline sack don dey protest mata of salary.

E pass 100 of di worker wey karey different paper dey sing go di head office say dem want their pension, salary, join with other tins wey dey vex dem.

One of di foma Training and Cabin Services Manager, Mrs Magdalene Onyeukwu wey say she start to work with Dana since 2008 wey di get Dem AOC just dey provoke.

She say di management not even fit consider di way tins be but just enta Whatsapp tell dem say their work don end.

Dem come dey ring bell make di Chief Executive Officer of Dana Air, Mr Jacky Hathiramani, come resin dem mata plus di ime month salary of April to pay dem.

Dana Air management never tok anytin about di mata fo now.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM