Delta State House of Assembly don passed amendment bill to change di name of University of Science and Technology, Ozoro, to Southern Delta University, Ozoro.
Na for dem plenary on Wednesday for Asaba nai dem decide am and dey wait for di signature of Govinor Sheriff Oborevwori to seal am.
Na Govinor Oborevwori first send letter to di Assembly on Tuesday make dem resin di mata and sharply make di legislature do first, second and third reading for di mata make e turn to law afta Emeka Nwaobi, di Majority Leader karey di motion for head and Charles Emetulu, wey dey rep Ndokwa West (PDP) folow support.
Speaker Dennis Guwor say dis move go epp di skool as dem change am to Southern Delta University, Ozoro cus new faculties go dey and other tins go folow.