+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Delta Don Get New Asagba of Asaba

Di 14th Asagba of Asaba nai di Asagba-in-Council don announce on Sunday for di Palace inside Ezenei kwatas wey go take over from Prof. Chike Edozien wey don die.

Put of 10 pipo wey bring name, na only Prof. Epiphany Azinge, SAN, nai dem see say he qualify and him na from Ugbomanta kwatas.

Prof. Azinge, hin na di foma Director of Nigerian Institute of Advanced Legal Studies, bifor he dey come out as di Asagba of Asaba and na Anthony Edozien wey be Ochendo Ahaba di Regent nai call di result.

With wetin di Traditional Rulers and Chief Edict of 1979 for Delta State tok, dem go follow am and go soon coronate di new Asagba.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM