+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Delta Govimet Warn Keke, Okada Riders To Register Bifor August 18

‎As Delta State Govimet don all Keke and Okada riders make dem go buy apron, I’d card, emblem and stickers but nor be all don agree to buy, dem don give two weeks grace period.

‎Govimet bin don say di resin wey make dem tell Keke and Okada to buy dis tins for small N7,500 na to make sure say security for di state dem fit track am.

‎For statement wey di Director of Public Communication/ Functioning Permanent Seke for State Ministry of Information, Harold Ojji tok on Monday, say di emblem, stickers, apron, nor be just karey buy as dem must buy am from Commercial Motorcycle and Tricycles Operators’ Association (COMTOA) Office wey dey different part of di state.

‎Di two weeks grace wey period go end for August 18 and any Okada or Keke wey not get di proper tins, if hand touch dem Directorate of Transport Vehicle Inspection Officers wey be VIO, Security Agents and Commercial Motorcycle and Tricycle Operators’ Association, Delta State (COMTOA) Task Force go sieze di Keke.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM