+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Delta State Ready Plans To Fight Crime

Di way crime take dey high for some part of Delta state don make Govinor Sheriff Oborevwori give strong warning to Local council chairmen say anytime dem play with di monthly security council meeting, e nor go easy with that pesin.

‎On wey dem dey do di stakeholders meeting for Asaba nai Govinor tok say dem go start use modern technology wey go epp di stats fight crime and he come tok say di way di LG Chairmen dey behave nor be so cus dem suppose dey fight corruption from di grassroot.

‎Di resin for di meeting na how to fight crime and any chairman wey match line nor come dem go purnish am and even fit suspend am.

‎Govinor Oborevwori come say di kidnaping, cult gbege and killing even drug abuse sef join all di tins wey dem dey tok and from now on dem don map out system to use wey go epp so state security.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM