+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Di 2027 General Election Timetable Wey Come Out Na Fake — INEC

INEC say dem never bring any time table for 2027 general elections as some amebo tori dey spread for some platform online.

Na for inside statement wey INEC bring come out for evening nai dem take say dat tori title ‘Breaking: INEC Releases Timetable for 2027 General Elections,’ na heavy lie cus nor be dem nai evem bring dat kind news and no know who don dey epp dem do INEC work.

Di election bodi come say dem know say with di news pipo go dey get double nind for di 2027 election but make pipo relax as notin like dat go hapun cus no wayo election go hapun for next year.

Dem come still say any tori wey dey spread and e nor come from dem Facebook, Instagram, X hakant or statement wey dem tok by demsef, make nor bodi belive am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM