Mohammed Sani Musa, d senator wen dey represent Niger East don talk say dis one no be the time for any motion wen dey seek the impeachment of President Muhammadu Buhari.
Wen Musa dey raport with news people for Abuja on Tuesday, he come talk say impeachment na another “crisis” wen the country no need.
Musa yarn dis one after dem ask am why lawmakers neva make any move to remove Buhari from office becos of d security situation wen dey worse for Naija.