Di hard law wey Senegal don put say any pesin wey dey do man and man or woman and woman relationship na 10 years nai di pesin go get free hakomodation for prison.
Di law na to stand with di promise wey President Bassirou Diomaye Faye,and di Prime Minister Ousmane Sonko, tok for election say dem go make am hard for any pesin wey dey act like dat.
Pipo sef wey dry suport homosexual if dem catch dem na straight pruson for teree or seven years.
But UN rights chief Volker Türk say di law too hard and nor good for LGBT pipo cus dem too na human beings.
