+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Dokitors Use YouTube Video Do Operation For Imo Woman Wey Get Belle

Di pesin wey get Lebechi Hospital for Owerri, Imo State, police don arrest am afta dem dokitors use YouTube video deg do CS operation for woman wey wan born.

‎For video wey di late woman husband, Mr Onyekachi Eze post nai there he take explain wetin di dokitors do as dem dey watch di YouTube video dey do di operation for him wife wey get belle.

‎Eze say he karey him wife go hospital wey she dey labor then dokitor come say dem get to do her operation as she don already dey bleed.

‎Naso di female dokitor call anoda dokitor make he come do di operation. But Eze sat for he korokoro eye di dokitors deg watch how dem go take do di operation for YouTube video, na that process di wife and di baby take die.

‎Police Command for Imo State don arrest di owner of di hospital and di nurses but di dokitors wey do di operation don run.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM