+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DRC Pipo Run From Village Afta ADF Rebel Raid

Villages wey dey Northern Democratic Republic of Congo, DRC, don dey hear am from rebels wey dey attack dem every time as di rebels say dem don him bodi with Islamic State, come dey cause problem for di kontri.

On May 4 and 7 nai Allied Democratic Forces, ADF, go attack Baswagha-Madiwe group and Beni territory (North Kivu) wey more than 80 pipo die inside.

Wetin di tokpesin of army wey dey for North Kivu province, Lieutenant Colonel Mak Hazukay tok, say na Friday nite nai di attack take worst pass as di ADF go finish Masala, Mapasana, and Mahini villages.

Dem still burn houses, tiff 25 Okada and kill 30 pesin for Masau, Mununze, Kabweke, and Manlese villages two weeks ago.

Many pipo cause of fear don run go Kyatsaba, wey dey for Western part of Beni and Mabalako to go stay and even hospital sef, full with patient wey dey find dokitor to treat dem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM