+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DSS Arrest Coach Wey Wan Play Away Match With Football Player For Osun

One of coach Adebisi for Osun State inside Osogbo don land for DSS hand afta he try to sleep with one small boy.

Dem say na on wednesday last week ni DSS take get tip off from of wetin di suspect dey do with small boys nyash.

Pesin wey nor wan gree call hin name say na on Sunday nai hand touch Adebisi afta he go football training session for Fakunle Comprehensive High School, Osogbo come dey eye one Micheal.

He come karey Micheal go one kona dey touch hin private part, na there one guard see dem waka pass but di coach never finish work s he still tell di victim to come meet am for house.

Micheal say he block come block di coach but pipo tell am to tok with am so that dem fit catch am, naso coach Adebisi give am address to meet up.

Na as Micheal dey inside di room he dey chat with pipo for outside wey dey give tip to DSS as dem dey enta oga coach don already remove di boy clothes dey touch bodi.

Even di Director of DSS Directorate of Public Relations and Strategic Communications, Dr Peter Afunaya say dem don arrest Adebisi and dem dey do investigation on di mata.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM