+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

DSS Don Release Comrade Joe Ajearo Afta NLC Promise To Cus Kasala

Department of State Security (DSS) don bow down to wetin Nigeria Labour Congress, NLC, tok say dem go cause kasala if dem nor free dem national Presido Joe Ajearo bifor 12 midnite yesterday.

Na around 11:25 for nite nai DSS come release Comrade Ajaero afta NLC don do meeting with di National Administrative Council of NLC thru di Deputy Prince Adewale Adeyanju say if govimet want peace make dem do di needful.

Bifor di new day go start naso DSS free Ajearo. Na presidential candidate of African Action Congress, Omoyele Sowore, nai first tok for X for nite bifor NLC officials, dem lawyer Deji Adeyanju come confam di release.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM