+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

ECOWAS Send Letters To Mali, Niger, Burkina Faso — Benjamin Kalu

Ways and methods nai ECOWAS Dey use take tok to Burkina Faso, Mali and Niger wey vex comot from di bloc.

Benjamin Kalu wey Nigeria Deputy Speaker nai tok for joint meeting of Parliament Committee on Administration, Finance, Budget, Public Accounts, Macroeconomic Policy and Economic Research wey dem do for Abidjan, Cote d’Ivoire, say di way di teree Kontri take dey nack chest to comot from di regional bloc dem dey resin am seriously.

He say dem don send letters to dem and e nor go tay, representatives go dey visit di kontri to tok with di head of govimet.

Kalu, nai dey as di chairman for di parliament committee, tok say Burkina Faso, Niger and Mali na family and dem nor fit troway dem for one side cus everyone need everybodi.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM