Two pesin wey dem name join for di case of foma Kogi State Govinor, Yahaya Bello, nai EFCC tell court to give dem administrative bail as dem reach court today Thursday.
Di counsel of EFCC, Jamiu Agoro nai tell Justice Maryann Anenih of Abuja High Court say Umar Oricha and Abdusalami Hudu wey dem out fresh charges for dem head join Bello dem wan free dem.
He say di 30 days period wey dem give Bello to come court to show hinsef still dey and never expire so make dem allow Oricha and Hudu get bail first till that time.