Di Govinor wey just komot from Delta State, Ifeanyi Okowa don land for Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) afta dem arrest am say he chop di state moni put for pocket.
Dem arrest Okowa cus of N1.3 trillion wey be di 13 percent derivation fund wey dey come from federal govimet to all state wey dey produce oil from 2015-2023.
As e be dem say Okowa use he office as Govinor take dey tiff di moni, use am buy property and other tins keep under bed bifor dem catch am on Monday.
.
Even tokpesin Dele Oyewale, say dem arrest Okowa when he come dem office for Port Harcourt but he nor gree tok more than that.