As quiet fight dey go on between gospel singer, Mercy Chinwo and Music Manager, Ezekiel ThankGod Onyedikachukwu, wey everybodi know as Ezee Concept sotay dem come even use Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) put for di mata, dem don close mata for arrest.
Na on Friday for Federal High Court for Lagos nai dem take cancel arrest mata against Ezee Concept afta di petition wey EFCC don already karey go meet court.
Naso lawyer Bilikisu Buhari wey be EFCC lawyer tell di judge, Justice Alexander Owoeye say dem dem nor want that part again.
EFCC don bin dey try to arrest Onyedikachukwu cus of say he nor use $345,000 of moni wey come out from di music well and even di songs of Chinwo dey online, she nor know how e dey waka pass.
Di fight come dey hapun between di singer and manager since, wey di singer say she nor know how moni dey waka pass.