+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

El-rufai Don Sue Kaduna State Assembly To Court For Wayo Mata

Di foma govinor of Kaduna State, Nasir El-rufai don use vex karey di State House of Assembly pipo to court cus dem say he nor do well for he tenure.

Na on Wednesday nai El-rufai karey di case to Federal High Court for Kaduna say make dem call di House Committee to come tok wetin he do cus even him di committee nor give am chance to fit tok he mind.

For April nai di State Assembly set up a committee to look how di past administration take use moni wey dem borrow, for contracts and other tins but dem come get to know say na a whole N432 billion nai dem nor know how e waka pass.

As di House Committee report sag di foma govinor hand nor clean nai di word dey pain am as El-rufai don send he lawyer Abdulhakeem Mustapha, SAN, to go petition di House.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM