+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

El-Rufai Move From EFCC To ICPC Frying Pan

Economic and Financial Crimes Commission say dem don free di foma govonor of Kaduna State, Malam Nasir El-Rufai afta he don stay teree days for dem hand. But operatives of di Independent Corrupt Practices Commission and Other Related Offences Commission come rearrest am as he dey come out from from EFCC building.

Statement from ICPC Head of Media and Public Communications, Mr. J. Okor Odey, confam say El-Rufai sleep for dem hand yesterday nite.

El-Rufai on Monday nai use he leg waka ho EFCC office fir Abuja cus of di case against am say he go tap di phone of di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, to hear wetin he dey tok with pipo and he even boast about am for TV.

Only EFCC on dem own come add salt for di case as dem come reopen do case of one lecturer Abubakar Idris aka Dadiyata wey lost for 2019.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM