+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

#EndBadGovernance protest: Human rights group,others don condemn treason charge

The National Human Rights Commission, NHRC, don condemn the treason charge wen the Nigeria Police Force enter against smallie dem wen dem accuse say take part for the recent EndBadGovernance protest wen hold for across the country.

The rights body, through their Executive Secretary, Mr. Tony Ojukwu, SAN, say d smallie dem wen dem carry go court becos of d report say dem dey make attempt to overthrow the government of President Bola Tinubu, “clearly dey against national, regional and international laws.”

Even as dem dey hail the Attorney-General of the Federation and Minister of Justice, Prince Lateef Fagbemi, SAN, for d way wen he take tell the police to transfer the case-file to him office for review, the Commission come blast the Federal High Court for Abuja for imposing wetin dem describe as “harsh bail condition” wen go dey impossible for the accused teenagers to fulfill.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM