+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Enugu Village Don Karey Govimet Hospital Give Juju To Protect

Village pipo for Ogurute Ulo community fo Igbo-Eze North LGA for Enugu State don karey hospital wey govimet build for dem give dem juju make em be di security of di general hospital.

Di community pipo dey cry say di way pipo take dey come tiff tins for di hospital like ambulance, TV, solar panel, join with other tins wey govimet put to epp sick pipo nor just good.

One of di men wey be like na em be di Oga come dey speak for Igbo dey beg di juju make e protect dem cus dem don tire for di everyday tiff and dem nor even know who dey do am.

Di man say all of dem for di community don gree to hand over di General Hospital to di juju and any man or woman wey say he nor like am or he hand dey for tins wey dey lost for di hospital, make di juju deal with am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM