Video of Baltasar Engonga wey be di Director General of National Financial Investigation Agency for Equatorial Guinea, scatter everywhere as dem see over 400 sex tapes did he house and office wey he take dey nack him broda wives and other women.
Na officials of ANIF nai see di video CDs did he office wey dem dey investigate di 54 years man.
Cus of di way di kerewawa video don already for social media, nai di kontri Govimet tell di telecommunication company for Equatorial Guinea make dem make pipo nor fit dey transfer audio, video or any file with dem data for WhatsApp.
Many of di pipo dey complain as dem nor for use WhatsApp take send tins unless say na WiFi, while di govimet say di move na to reduce wetin nor good wey pipo wan send.