+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fake Cancer Mericin Dey Market – NAFDAC

National Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) say make pipo shy eye bifor dem buy one mericin Mabthera 500mg/50ml, wey dem take dey treat pesin wey get cancer as fake don dey market.

Na dokitors pipo wey fess dey Kaduna and Gombe State nai fes notice di fake injection bifor Roche Nigeria di kompani of di drug kum say di fake mericin karey N2110A09 as di badge nuba.

Dem dey use Mabthera, wey di name na rituximab, take dey treat serious siknes like blood cancer and some oda strong siknes.

Dokitors say dem dey buy d8 fake injection for N160,000 to N275,000, wey dey very cheap from wetin market price be and dem notice am from patient wey go buy am outside.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM