+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fear For Customers As CBN Cancel Heritage Bank Licence

Di Central Bank of Nigeria, CBN, don tell dem acting Director of Corporate Communication, Hakama Sidi Ali, make she take back di licence wey Heritage Bank dey use work.

Na on Monday nai di news just come outside, cus dem say di bank nor dey fit meet up.to standard.

Wetin CBN tok for di statement wey dem release be say di bank management and board nor fit improve on dem system and instead of dem to go fall for gutter e beta make dem stop now.

Di Director say CBN don try different way to take epp di bank but all of dem just nor work and even dem as bank nor even know how dem wan do to take get moni, so to save di problem make dem just close.

CBN come still say dem own na to make sure say pipo nor fear banking sector for di kontri so dem get do their work.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM