+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fear Make Pregnant Woman Form Kidnap For Ogun State

One pregnant Mrs Rahemat Lateef wey her husband Ogunbunmi Lateef, go report to police say kidnap don tiff her, di Ogun State Command say dem don see her for Kwara State.

On Thursday nai Mr Lateef cry go station say he wife wey go born today tomorrow go di state general hospital for Ijaiye, Abeokuta but bifor he know wetin dey hapun some unknown gunmen don send am WhatsApp message say dem don tiff he wife.

But for X nai di tokpesin woman of di state police command, SP Omolola Odutola, say di kidnap na fake cus di woman just dey try run from her husband bad mouth since he mind don already dey to welcome new baby.

Rahemat don dey always get belle but di belle dey always fall, so as dis one hapun again to avoid all di curse and reaction of her husband nai she kukuma say dem don tiff her, she come travel to he papa place for Kwara State.

Na di process of police to find Rahemat nai she take show with her papa for Abeokuta.

Di tokpesin of police say dem don carry her go meet dokitor to attend to her and she dey safe now.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM