+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Federal Govomet Don Hire U.S Firm Wey Go Dey Epp Check How Christian Dey Kpai

As pipo dey shout say terrorists dey kill Christians for Nigeria and FG say na lie but US govimet say na true, FG don go pay 9millon dollars to one US Lobbying to dey tell US how Christains take dey suffa for terrorists hand.

Di contract of di lobbying firm na US Department of Justice na file am with, Aster Legal one law firm wey dey for Kaduna State, plus di DCI group wey US public affairs and lobbying firm on di behalf of Nuhu Ribadu wey be national security adviser for Nigeria.

Dem say di contract suppose stay for six months till June 30, 2026, and dem go automatic karey am to anoda six months according to wetin Oyetunji Olalekan Teslim, wey be di managing partner of Aster Legal, and Justin Peterson, managing member of DCI group, sign on December 17, 2025.

Di work of di lobbying firm na to epp Nigerian govimet thru Aster Legal dey tok to US on how FG dey do to protect Christian communities and as US govimet don tanda to fight jihadist group wey nor dey make di kontri dey rest.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM