Nigeria government in collaboration with Department of State Services (DSS) and Nigeria govimet don provoke for Facebook, X and Omoyele Sowore cus of wetin he go write against President Bola Tinubu.
DSS come karey am to Federal High Court for Abuja charge am with five-count cus dem bin don give Sowore 7 days make he delete wetin he write for social media or face anytin wey come.
Some days ago wey Presido Tinubu travel to Brazil come say di kontri don beta na di tok make Sowore go write for Facebook and X say Tinubu dey lie and na big tiff.
Nai DSS say why he go use that kind word wey fit cus gbege for di kontri so make he delete am, dem come even tell Facebook and X to delete am as Sowore nor gree but dem too nor gree delete, so di Director of Public Prosecutions of Federal Ministry of Justice, Minister Muhammed Abubakar and lawyers for DSS nai stand for di mata.