Federal Govimet wey heap case of moni laundering for Binance Holdings and di executive, Tigran Gambaryan, dem don take back di case.
Na on Wednesday nai govimet make u-turn for di charges wey dem bin give Binance.
Remember say EFCC bin arrest Gambaryan and he second, Nadeem Anjarwalla, but Anjarwalla run from National Security Adviser office where dem take keep di two executive, bifor dem come karey Gambaryan go dey for Kuje prison.