+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Say Dem Not Sale Bag Of Rice 40k Again

Fediral Govimet say dem nor go sell di 50kg bag of rice wey dem bin wan sell to civil servants for 40k again.

Di resin wey make dem change mind no bodi know but dem put am for circular wey di Ministry of Special Duties and Inter Govimet Affairs signed thru di Director of Human Resources, Aderonke Jaiyesimi.

Na August 2 nai dem take write di circular of withdraw and nor resin dey why FG stop di program for or weda dem go start am again.

Bifor now FG bin say civil servants go fill Google form from di Office if Head of Civil Service bifor dem go fit buy di 50kg bag of rice for 40k and do chairman for Joint Union Ministry nai go supervise di process make wurowuro nor dey inside.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM