+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Stop that SAMOA Agreement First, We Wan Check Sumtin – House Of Rep

Di House of Representative member, Aliyu Madaki don move motion for dem meeting say make federal govimet stop di SAMOA Agreement cus of too many tok wey dey around am.

Nai di whole House come gree togeda tell President Bola Tinubu on Tuesday say e go beta make dem pause for di agreement as dem.get dey sure if dis LGBTQ gay mata wey pipo dey shout say dey inside.

Di SAMOA Agreement na from European Union relations with 79 countries wey dey inside and dis one na 48 African kontri, 16 Caribbean, and 15 Pacific kontri.

As di tok don too much nai di House set Committee on National Planning wey go do beta investigation about di whole issue to know wetin really dey inside di loan wey Nigeria Govimet wan kolet , then make di committee come back with feedback afta one month.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM