+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Foma MTN CEO Die Of Cancer

Telecommunication giant for Nigeria and some side of Africa kontri dey cry today as dem foma Group CEO of MTN, Sifiso Dabengwa, die of cancer today, Monday.

Na Dabengwa family pipo from Zimbawe thru dem tokpesin nai, Themba Sibanyoni, nai confam di news fo some MTN South African media outlets.

Dabengwa from March 2011 till 2015 nai he take be MTN CEO bifor he resign wey Nigeria hammer MTN 1.04 trillion naira cus over five million pipo Sim not dey register.

One top executive for MTN headkwata for Johannesburg, South Africa, say na cry all of dem dey for Dabengwa, wey bin dey as CEO of MTN Nigeria for 2006.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM