+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Food Go Soon Yakpa, Make Una Nor Worry – Presido Tinubu

As Nigeria dey celebrate dis year 64th Independence Day celebration, Presido Bola Tinubu say dem go do 30-day National Youth conference, so that all di pain wey dey face di kontri dem go rub mind togeda.

Na for di State House nai Presido take dey give di assurance for hin independence day speech say tins wey dey affect Nigeria youth like work, skool, and other tins go be tin of di past.

He come still say high cost of food and living wey lilo dey complain about go soon end cus nor be only Nigeria nai di tin dey touch but laslas everybodi go dey okay.

About di youth Confab, Presido come tok say dem go pick some pipo wey go stand as to represent dem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM