+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Four Pipo Don Enta Okuama Cutlass, Just AS Army Leave Village

E be like say na new problem wan hapun again for Ewu Kingdom wey he never even reach one full day wey sodja komot from Okuama community as dem don cut four pipo.

Pipo wey dey stay for Akugbene inside Bomadi LGA and dey share boundary with Okuama say di Okuama pipo wey come back from inside bush nai don go catch and cut four of dem village pipo.

Bifor now, Vanguard don tok say say pipo hear say army don komot from Okuama naso dem dive enta di village like fish dey tiff rod, zinc, iron and other tins.

Wetin on source from Akugbene tok, hin say four pesin dey pass di leg road to Ezebiri make dem reach Okuagbe go buy cheap food as dem hear say army don komot from di road.

Na wey dem dey go Ezebiri nai Okuama pipo wey just dey come back from bush back to dem village attack di Akugbene pipo, use cutlass cut dem but one fit run while dem drag di others go di village jetty.

But other pipo dey tok say di pipo wey Okuama cut na those wey come tiff for dem village afta dem hear say army don komot from di community.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM