As di President-General of Okuama community, Pa James Oghoroko don die afta army catch him and five others go lock for where no bodi know since August 18 and 20 sotay di PG come die there, di pipo don dey do protest to ask for justice.
Na on Sunday nai dem start am, though say dem nor karey wahala do am but di pipo belle nor sweet as dem dey vex di way army dey do dem.
Cus of am, dem give govimet and army 7 days to behave well and bring dem leaders and release di deadi bodi of dem PG or face di problem.
Dem say di community pipo go block River Niger if di 7 days finish cus dem too na humans wey need beta treatment from President Bola Tinubu and Nigeria Army.