To make sure say women wey get belle nor dey karey die anyhow as dem wam born pikin, Federal Govimet thru Minister of Health and Social Welfare, Prof. Muhammad Pate, don announce say na free women go dey go operation from now on.
Na during dem teree days Nigeria Health Sector–Wide Joint Annual Review for Abuja, nai deme take bring di new level so that e go reduce di way women and new born baby take dey die for di kontri cus dem nor get moni to karey out operation.
Di Minister say e nor be beta tin say woman wey dey bring life, go come die did di process cus of say dem nor get moni to karey out operation.
Right now di new scheme na for every woman wey poor or nor know how she wan take pay hospital operation moni weda na for private clinic or govimet hospital, di National Health Insurance Authority go take care of am.