+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Friends Hide Drug For Bread To Give Suspect Wey Dey Cell, Kaduna SCID

Na teree pesin wey wan karey hard drugs give dem pesin for inside police cell nai di Kaduna State Criminal Investigation Department dimon catch on Sunday.

Di pipo dem be 38 years John Solomon, Kunle Oluwale, 45 years, and James Daniel Baba wey be 45 years.

Tokpesin of di command, Mansir Hassan, nai say di teree men wey dey stay for Sabon Wuse inside Abuja, karey bread come give den pesin for di SCID come dey beg di charge room man to kolet di bread.

As dem dey beg di pesin wey be di Charge Room Officer to give di bread to one Gideon Amao wey dey inside cell na there police take notice di hard sruga wey dem hide inside di bread.

Right now di teree of dem dey with police to know who send dem, why dem want make di suspect wey dem dey investigate high plus other kwestun.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM