Di govimet of Ghana don remove military leader name, Kotoka name from di international airport cus he overtake dem founding fada in those days.
Maj. Gen. Emmanuel Kwasi Kotoka na soja wey join with oda sojas porchu Kwame Nkrumah komot from office for 1966 but anoda military group come kill am di next year for di airport.
Nai di military govimet for 1969 come change di name of di airport to Kotoka to honor di soja, say na him set Ghana free from Nkrumah bad rule.
Some pipo don dey say Kotoka way no follow Ghana democracy so afta 60 years nai di new govimet come remove Kotoka name from di international airport and take am back to di name wey e be bifor Accra International Airport.
