+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ghana Too Stubborn, Dem Leave John Go Vote William, NNP Foma Member

Na cus of say Ghana too stubborn nai make una leave John go dey vote for William, na una don see di result.

Na wetin di foma New National Patriotic member, Hopeson Adorye tok as he use style take dey yab President Nana Akufo-Adoo for campaign event of John Alan Kyerematen wey be di leader of Change for Movement.

Di foma NNP member say since 1992 wey dem start to vote for president na pipo wey dem name get John nai don dey di seat, like deme Jerry John, John Kufuor, John Mills, and John Mahama.

He say but for 2016 nai di kontri go make di biggest mistake to troway John and go vote for William and di tin don dey clear for everybodi eye now.

Alan na foma appointee for President Nana Akufo-Adoo govimet and dey wan contest for di election wey go soon come for Ghana.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM