President Nana Akfuo-Addo of Ghana wey he time for office go soon finish afta di two tenure wey he don rule, nai dey face tok from he kontri pipo cus of image wey he karey put for Western part of di kontri.
Di minister of Western Region, Kwabena Okyere Darko-Mensah, on Wednesday, nai put di Presido image for front of Effia Nkwanta Regional Hospital, say dem use am to honor di president for he good work.
Some pipo just dey provoke for di image , call am yeye tin wey nor make sense and even di opposition party member Emmanuel Armah Kofi-Buah say no be image nai Western Region need but to get beta epp.
Even as some dey vex for social media, others dey hail Akfuo-Addo say he try and do beta work wey Ghana pipo see clearly.