+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govimet Don Gree To Increase Minimum Wage

Federal Govimet don gree say dem go increase di new minimum wage wey dey hang for N60K to amount wey go make sense.

Dem nor tok how much dem wan increase am to but di tripartite committee say dem go dey meet every everyday for one week so that dem go agree on di new minimum wage to pay.

Na for nite on Monday nai govimet hold meeting with Nigeria Labour Congress and, the Trade Union Congress inside di office of di Secretary General of di Federation.

Na there dem come dey togeda sign agreement with President of NLC, Joe Ajearo and Festus Osifo of TUC then di pipo wey sign for govimet na Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, and Hon. Nkeiruka Onyejeocha di Minister of State for Labour and Employment.

Di statement come still say make workers nor fear of any punishment cus of di strike as govimet nor go resin dat side.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM