Di 13 students wey gada drop wotowoto for SS1 day student for Federal Unity College, Enugu State nai Govimet don suspend afta di video wey dem take dey flog di boy go viral on November 7th.
For statement wey Minister of Education, Dr. Tunji Alausa thru hin Director of Press and Public Relations, Ministry of Education, Folashade Boriowo, bring on Wednesday nai say dem suspend di boys for teree weeks.
Di minister say dem don set up disciplinary committee wey dey look di mata and go come out with dem report cus skool suppose be where pesin go learn and dey safe.
Alausa come still say dem don already send law enforcement agent to go di skool cus of security and e go give dem enough time to check oda tins.