Popular Kaduna preacher wey be medical doctor bifor and army captain, Sheikh Ahmad Gumi, don tok say Nigeria govimet know every terrosist name and where dem dey operate from.
Na wey Gumi dey tok for one interview for DRTV wey dem dey ask am how he take know where bandits and terrosists dey stay for di kontri nai di Imam bust say no be only him dey do.di waka for north.
According to Gumi, he nor dey any bandits wey federal govimet nor know cus when he dey go negotiate he dey karey police, military, and oda security agencies with am.
Even sef he dey let Emirs know wetin dey sup and sometimes women dey follow am enta di bush.
Federal Govimet neva tok any tin afta di accusation but pipo mouth don already open for ground.
