+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govinor Adeleke Nor Gree Court To Kill Man Wey Tiff Fawo

Govinor Ademola Adeleke of Osun State don put mouth for di case of one man wey court say he go die by hanging cus of fawo wey he tiff, di Govinor say di jorjimet nor just make sense.

Di Govinor say make di Attorney General quickly come put mouth to allow di man fit comot from prison bifor dis year go finish.

Na for statement thru he tokpesin, Olawale Rasheed, nai Adeleke take say Osun na land wey dey resin Justice and how everybodi go take dey equal, so dis kind jorjimet nor fit work.

He come tell di pipo for di state make dem mind come down as di mata na urgent one but for sure say di young man nor go just die like that cus he tiff fawo.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM