+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govinor Alex Otti Suspend Abia Commissioner Of Health

As e be say di Govinor of Abia State, Dr Alex Otti dey make sure say every tin for he govimet dey open, naso he don karey suspend di Commisoner of Health Dr. Ngozi Okoronkwo cus dem say she dey do any how for di office.

Wetin di Commissioner For Information and Culture Prince Okey Kanu tok on Tuesday, be say dem don dey start investigation to know weda wetin dem say Okoronkwo do na true or lie.

Naso dem take suspend di Commissioner till further notice afta di State Executive meeting on Monday say she don chop moni for di ministry and nor fit account for am.

Na di Permanent Secretary Ministry of Health, Dr Ifeyinwa Kalu nai go colabo with di Special Adviser to Govinor on Health, Dr Mrs Ngozi Azodo to take run di ministry for di main time until dem finish investigation for Dr.Ngozi Okoronkwo head.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM