Many of di Keke rider wey dey for Warri and Edjeba no fit hold am again for di too much levies wey dey press dem like heavy load as dem dey beg di state govimet to come epp.
On Thursday nor be small cry nai di Keke riders dey cry as dem say VIOs, Okowa police, DESTMA dey wan use aprons and baskets take press dem neck and dem don say dem nor want am, come join di everyday N300 wey dem dey pay for ticket and other levies.
Di Keke rider say di way security agencies dey behave, to buy Keke now na who chop belleful and some oda tins nai dey realy affect dis dem business and nor dey make dem see beta moni karey go haux.
Thou di N300 wey dem dey pay everyday dey epp abgero not to disturb dem but dem say if that moni na wetin dem save for one year e go build haux ontop water, so make epp come to their end bifor tins bad pass as e dey.