Rivers State Gov, Siminalayi Fubara don sack di commissioners, and other public officers wey he put for position but he greet dem say dem try for di two years wey dem work with am.
Di pipo wey di Govinor sack na those one wey Supreme Court say dem nor suppose dey position afta di emergency rule finish.
Na for Port Harcourt govimet House on Wednesday wey dem dey celebrate Nigeria 65 Independence Day nai di Govinor take say he don serve di commissioners breakfast.
Govinor come still greet di pipo for di state as dem stand with am come say make di whole kontri stand with President Bola Tinubu as na unity nai di kontri need even for dis independence.