+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govinor Obaseki To Pay 70k As Minimum Wage To Edo Workers

Govinor Godswill Obaseki just dey make workers for Edo State dey dance reach ground afta he announce say dem don increase minimum wage.

Na just last week here nai govimet of Lagos state tok Dem own say na N70k dem wan dey pay workers for di state as minimum wage bifor Edo dey tear ground so.

Na wey Gov Obaseki dey open di Secretariat Complex for Labour Unions inside Benin City, nai he take shock di workers say dem nor go dey kolet 40k again but na 70k go he di new minimum wage as from May 1, 2024.

As for di Labour House wey dem newly open na afta Adams Oshiomhole, wey be foma Govinor of di state nai dem name am afta.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM