+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govinor Umo Wife Epp Woman Wey Give Her Children Fowl Food Chop

One 22 years woman wey her husband don die and she gets four children, Grace Emmanuel wey dey stay for Eket for Akwa-Ibom State nai her video spread for Instagram as she dey use fowl food and fish food take dey cook for her children to chop cus of hunger.

As Praise Uzoma wey be di farm owner pikin see wetin di woman dey give her children nai come video am make pipo for come epp di woman, as di video waka, di Govinor Umo Eno wife don give epp hand to di widow.

Naso Mrs. Patience Umo Eno donate 500k for Grace cus normally na 15k dem dey pay her for di poultry work.

On Tuesday for Uyo, wey di Press Seketary, to di Govinor wife, Mrs Uduak Ekong dey tok to tori pipo, nai she say Mrs Eno don buy kitchen tins, foodstuffs wey go last for teree months and beta house for di young widow.

Ekong says dem still wan make Grace go finish her secondary skool or learn trade but that one go be afta dem check her head if everytin dey okay.

She come say, di owner of di farm go still dey pay Grace 15k but di moni wey dem realize dem go put 20k every month, make di total for be 35k.

Di resin na say make boys nor go mumu di young widow as she na still small pikin, come take all di moni from her.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM