+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govt Dey Hear My Phone Tok- Sen Ndume

Senator Ali Ndume don drop anoda one on Thursday nite say govimet dey hear wetin hin dey tok for phone but dem nor fit do di same tin to bandits phone.

He say di tin dey make am wonder for di security 9f di kontri cus plenti pipol don warn am make he know wetin he dey tok for phone cus govomet dey track am.

Na for Channels TV nai he take dey yarn so but Ndume say he nor see am as problem cus Nigeria wahala don plenti, where det worry am na how govomet go fit hear wetin he dey tok for phone but dem nor go fit hear wetin bandits and terrorists dey tok for phone.
Ndume say, track system dey every part for Nigeria but govimet nor fit use am sotay terrosist dey come TikTok dey show demsef.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM