+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Group Tell INEC To Stop CRV Registration For Warri Cus Of Wayo

Some pipo wey dey protest and karey banner of map wey dey with Ijaw and Itsekiri communities go di headkwata of Independent National Electoral Commission (INEC) for Abuja.

‎Di leaders dem be from Warri federal constituency and dem karey different paper wey dey tok say dem nor want di Continuous Voter Registration (CVR) for Warri Federal Constituency again cus wayo too full am from di units to di wards.

‎Dem say make INEC release di report of Supreme Court wey give order about electoral registration areas, wards, and polling units for Warri federal constituency sharply.

‎Dem still come say kpatakpata make INEC stop di CRV registration cus e nor folow di law wey court don put already for Warri pipo.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM